I Dey Feel Iyanya No Be Small- Juliet Ibrahim

iyanya-juliet ibrahim-ngtrends
If Yvonne Nelson catch you ehn!  yes you Juliet Ibrahim na you I dey talk to. Ok here na wetin happen- no be news again say naija music bad boy Iyanya be don use and dump Ghanaian actress Yvonne Nelson. The mata pain most Ghanaian actresses so tey dem no wan dey follow Iyanya dey talk anymore.
E reach level wey be say Iyanya call Yvonne Okoro to come dance with him on stage for the last Ghana Music Awards and she no gree dance with Iyanya. The thing pain Iyanya no be small so tey Iyanya wan drag am go stage by force to dance with her.
iyanya-juliet ibrahim-ngtrends-2
As the mata dey so ehn, no Ghollywood actress wan follow Iyanya talk or even have anything to do with him because of say he break Yvonne Nelson heart. But juliet Ibrahim don talk her own mind for AY Show say she dey feel Iyanya but no be only Iyanya, she talk say she dey feel Flavour too.
Yawa dey o!
- See more at: http://www.ngtrends.com/gists/dey-feel-iyanya-small-juliet-ibrahim/#sthash.9EbHcnIN.dpuf

0 comments:

Post a Comment

DROP YOUR COMMENT

 
Top